Go Beyond Local Pidgin, Gist for Naija and Obodo Oyinbo

ABOUT GO BEYOND LOCAL PIDGIN – WHO WE BE?
If dem tell you say Pidgin English no fit go international, na lie be dat o! We don break dat table!
Go Beyond Local Pidgin no be anyhow platform! We dey show say Pidgin no be only for backyard – e fit waka go far, pass barrier, enter global level.
For any domot wey we dey, e get plenty barrier wey hold pesin down but we no gree. We sabi say limits na wash and e no pure!
Go Beyond Local Pidgin na for anybody wey wan carry matter beyond domot, make e touch global.
OUR MISSION – WHY WE DEY DO WETIN WE DEY DO?
Our mission clear like fresh palmwine – to make sure say your brain no go everly dull.
HOW WE TAKE START?
Na today? From 2024, we see say Pidgin na correct tool wey we fit use gist business, entertainment, and other tori dem. We bin start small o, but we sabi say wetin get leg go waka.
Our waka no dey finish! Na everyday we dey find new way to make sure say Go Beyond Local Pidgin dey Waka go front. We dey try build something wey go connect business, wey go dey give information wey go help people reason am.
FOLLOW US, YOU NO GO LOSS
Pidgin no be local again o! – As you sabi wetin dey and you be business owner, or person wey wan enter international level, follow motor wey dey go.
We sabi give beta tori! – No be anyhow nyama nyama tori, we dey drop confirm gist for politics, tech, finance, entertainment, business and more.
NO CARRY LAST – FOLLOW MOTOR WEY DEY GO!
Reason am, you know say “who first go market, first sell market!” No let gist waka pass. Go Beyond Local Pidgin na the new wave wey dey yan Pidgin tori. For business o, entertainment, or personal matter – we dey carry correct gist come your domot!
#GoBeyondLocal #Pidgin #PidginGist


Politics
Natasha Akpoti-Uduaghan Wahala For Senate


You know dat kain strong woman wey no dey fear anybody? Dat na Natasha Akpoti-Uduaghan for you! Dis woman no be small pikin, na senator wey represent Kogi Central, and before she enter politics, she don already dey hustle as businesswoman and activist. She no carry last when e come to courage, because she face all dem big politicians for her state win her seat like say na WWE wrestling match.
For Nigeria politics, if you no get “godfather,” dem fit try use you play. Natasha marry Chief Emmanuel Uduaghan, who na close friend to Senate President Godswill Akpabio. At first, you go think say dis connection go make life sweet for am for Senate, but e get as e be!
How dis matter take start? Chill make I gist you.
One February morning for 2025, Akpabio wake up, con begin dey rearrange seat for senate like say na him parlour. Him no tell Natasha before him shift her from her fine seat to one seat wey dey for corner wey be like say e dey near toilet. Natasha see am, she vex. She stand up for Senate chamber, shout say, “I no go move from here! You dey punish me because I no gree do your bidding!”
Senate people no con like dat kind talk! Dem con accuse am sey she break rules, con carry her case throway give Ethics Committee—like primary school teacher for headmaster office.
But Natasha no be woman wey go keep quiet. Few days after di seat wahala, she carry her matter go Arise Television, drop bomb wey make everybody mouth open like say dem dey chop agbado. She talk say Akpabio don try to toast am for him house for December 2023! According to her, the man hold her hand, tell am say if she wan her motions to pass for Senate, she must “take care of him” You know wetin dat mean?
She even compare Akpabio to those university lecturers wey dey fail students wey no gree sleep with dem. Na wa o!
Akpabio deny am wella, and him wife, Uloma, con enter matter full-time. She call Natasha liar, carry am go court for defamation.
Some people con dey talk say instead of dem to investigate Natasha serious allegation, Senate just dey focus on punishment for sake of sey she no wan siddon for her new seat. Dem suspend am for six months, cut her salary.
People vex because Proper Investigation no follow, say dem no even ask Akpabio any question. Na only Natasha dem dey punish. And people dey vex say fellow women for senate No even Support Natasha. Hmmmm na true o, not even one woman stand with Natasha. Na only women groups outside dey shout.
Natasha no gree, she run go court. At first, court support am, but as e be like say somebody fex muscle, judge con recuse himself like say him see ghost. Abeg no vex for that grammar, recuse mean say Judge wash him hand for the matter.
Ok, make we continue di tori. By March 2025, Natasha don carry her protest reach United Nations! She stand before Inter-Parliamentary Union (IPU), she dey there dey tell di whole world say Nigeria Senate suspend am because she talk say Akpabio harass am.
Dem no like dat one for Senate o! Dem begin yarn say she no get right to speak since dem don suspend am. Dem even ask security to find out how she take enter the meeting!
But now INEC Just Hammer Final Nail for petition wey dem give INEC to comot Natasha.
Natasha Akpoti-Uduaghan just collect win! As dem dey drag her up and down for Senate over Akpabio matter, some people for Kogi state carry petition go INEC, say dem wan comot am from Senate. Na wa o. But INEC look the petition, laugh, con throw am inside dustbin!
INEC say the constitution no talk make dem comot am, which mean say the petition no fit carry water, and which mean dat thing wey some lawyer dey always talk wey be Dead on Arrival. And Natasha sef don hail INEC say dem be “truly independent.” She thank INEC sake of say dem no gree bow to pressure from “undemocratic forces” as she put am.
Natasha yarn say, “The voice of the people na the voice of God! No be Yahaya Bello or Akpabio fit comot wetin Kogi Central people decide!” She even talk say she no dey fear because God and the people dey by her side. INEC decision sweet her belle well-well, and she call am correction of injustice. But make we no forget say this na just one battle on top the ones wey still dey front between her and Akpabio camp.
Now, make we talk about the elephant for the room, the sexual harassment allegation wey Natasha throw. You see eh, if you ask me eh, my opinion be sey dis one na serious case, but e get one important thing: evidence. For court, na evidence dey win case, no be grammar or who shout pass. Natasha talk say Akpabio hold her hand for December 2023, tell am say if she wan her motions to pass for Senate, she must “take care of him.” you sabi wetin be motion?
Motion na that drama wey dey happen for Senate wey person go stand like town crier begin yarn like say na him get Nigeria. After the long talk, Senate President go adjust him agbada, raise voice shout, “If you agree, make you talk Yeh! If your belle no sweet, shout Nay!”
Once di people wey talk Yeh loud pass, him go talk ” The Yeh have it”, then everybody go dey nod head. Na that grammar wey the senator blow na him dem dey call Motion. E no dey move motor o, na just big big grammar.
Dis na hard truth o, but Natasha lawyer talk so dem get evidence. Akpabio don shake head deny am, him wife sef no carry last, she don drag Natasha go court for defamation. Now, as e be, once dem land for court, Natasha go need to show the strong evidence wey she say she get, because for this kind matter, na who bring better proof go fit win.
Some people don already begin yarn say, “She record am? Where the video? Where the audio?” But we sabi say sexual harassment matter no dey always get evidence. Sometimes na just your word against the other person own.
You see for street level, many people go quick believe Natasha, especially because for Naija, once power enter the gist, everybody go suspect the oga. But court no dey do like that. If you no show strong evidence, you just dey stress lawyer wey don iron him wig since 6am.
So if you wan accuse person of something serious, make sure you gather your evidence well-well before you talk.
As for Natasha, whether she win or lose, she don already write her name for history as woman wey no gree fear. But if she really wan win her case, she go need enough proof.
Corruption
Wahala wey dey follow money wey dem suppose use buy gun


No be small wahala wey don dey since dem knack Colonel Sambo Dasuki former NSA allegation say e misplace N33.2 billion wey dem suppose use buy machine gun. Di mata don turn long Nollywood series, e no gree finish. Since di wahala start, di tin don bend like k-leg, e go court, e come back, e go again, e return.
Oga Dasuki wey be former National Security Adviser for Goodluck Jonathan time, di same time wey di country dey reason how dem go take fight insurgency, na dat time e be like say money dey waka enter anoda direction. Na so EFCC knack Dasuki charge for December 2015 join some oda oga dem wey follow for di matter. Dem talk say di tin wey cause di wahala na how N15.5 billion waka comot for di treasury wey e suppose go fight Boko Haram. But as di matter come dey unfold, EFCC talk say di tin big pass di initial N15.5 billion, e be like say e get back pocket. By 2018, dem don add more sauce put inside di charge sheet, increase di money to N33.2 billion.
Di tin wey pain people pass na say di money wey suppose buy better weapons for soldier dem to fight Boko Haram, dem talk say e waka enter di 2015 PDP presidential election campaign. Some people even talk say di money no just vanish like spirit, e dey do political waka. For di new charge wey dem arrange for Dasuki, EFCC say di oga collect N10 billion from CBN say e wan arrange special security, but na for politicking di money enter. EFCC come talk say e still wire N1.45 billion go Acacia Holdings Limited, say na for prayer arrangement. Prayer wey suppose be free for God side, dem say na billion naira prayer Dasuki do.
EFCC no gree for di matter, na so dem go file fresh charge again for March 25, 2025. Dem carry Dasuki plus Aminu Baba-Kusa wey be former oga for NNPC, and two companies join di wahala. Na for Federal Capital Territory High Court for Abuja Justice Charles Agbaza front dem arrange di mata. But no be today Dasuki dey hear charge, so di man and hin guys just tell court say dem no gree, dem no do am.
As di tin dey hot, EFCC prosecution counsel, Oluwaleke Atolagbe talk say dem ready to show di whole film from episode one to di latest season. Di defence lawyers talk say make dem still maintain di bail wey dem already give di defendants before. Court come talk say make everybody go house go sleep first, dem go continue di matter for July 1, 2025. Na so di court adjourn di case.
Di allegation wey dey ground dey heavy like cement. EFCC say Dasuki no just chop di money anyhow, e use style spread am:
- N10 billion wey suppose dey for security, dem talk say na for PDP primary election di money enter.
- N1.45 billion wey suppose be prayer money, EFCC talk say di tin no enter heaven.
- N4.68 billion wey suppose build security infrastructure, EFCC dey yan say di money no even see bricklayer. Instead, e enter gubernatorial election campaign for Ekiti and Osun.
Di matter get serious political and legal implications. As e be, e don show say for Nigeria, to carry corruption case go court be like say you wan do snail race—e go slow, e go bend, e fit even sleep for road. Since 2015 wey di case start, e never reach last bus stop. Di thing con make pipo dey ask question: Why case dey delay? Why DSS bin dey hold Dasuki that time when court don talk say make dem release am? Na dis kind question dey make people dey reason say di whole tin get political K-leg.
For APC side, dem dey use di case shine, dey tell Nigerians say dem serious for dis corruption fight. But PDP dey yan say di matter na witch-hunt, say na selective prosecution wey be like “catch who you fit, leave who you wan leave.” Some people dey argue say if corruption fight wan make sense, make e no get party color, make e touch everybody wey sabi misplace money, no matter di party wey dem dey.
If we reason am well, di wahala wey dis kind mismanagement dey cause for Nigeria no be small. We dey fight Boko Haram, yet soldier wey dey front no see beta weapon, e go dey use old rifle wey dey sound like generator – tatatatata. Some tin wey suppose dey work for ground, na only for paper e dey. People wey suppose dey sleep well for night because government dey protect dem, na so so fear fear dey catch dem.
For EFCC, dis case na big deal. E show di kain problem wey dem dey face for di fight against corruption. Even though dem don dey since 2003, some people still believe say dem never too get di liver to hold some kain big men wey dey misplace government money. Some people talk say dem dey do selective prosecution, say some cases dey move fast, but some dey drag like Okada wey knock engine.
As di case don start fresh again, people just dey luku luku. Na dis kain case go tell us whether government serious for di corruption fight or na just another drama wey dem dey write for the end “to be continued” like one old film . If court finally see say Dasuki and hin guys really misplace di money, e fit change di way people dey reason government for accountability. But if dem escape di case, e go be another wahala because e go send wrong signal say e no matter how you use money anyhow, if you sabi di right people, you fit pam the case.
Dis Dasuki matter no be small pikin case. E be one of di longest-running cases for Nigeria for anti-corruption history. Whether e go end well or e go drag go di next government, na wetin some people dey talk. Make we just hope say justice go reach last bus stop before di case turn case wey nobody go everly hear about again. Hmmmmm.
Corruption
Wahala don burst for Senate Ethics Chairman matter


You go believe say person wey suppose dey judge ethics matter for Senate, him former waka for America now show sey e get wahala. Neda Imasuen, di oga wey dey in charge of Senate Committee on Ethics, don find himself for serious kasala as tori about im past don show for open for inside market square.
E no be today, but na now everything don cast. For 2009, one madam wey dem call Daphne Shyfield carry her hard-earned money, give Mr. Imasuen make e help am fight court case. Madam believe say she don jam better lawyer wey go defend am like lion, but na so di matter take bend.
Di woman say after she give Imasuen di money, e no con run di case well, and di mata con get as e be. New York bar people no dey play, dem con send am letter make e respond, but di matter no too gel. Dem call am, e no pick. Dem send paper, e no reply.
Before dem fit arrange di matter well, oga don waka enter Nigeria dey run politics. If you think say di matter go end for dia, you never hear tori finish. Na di same man wey get wahala for America na im dem con make Senate Ethics Chairman for Nigeria.
As e enter position, e con begin handle mata dem dey bring come im side. Last week, Natasha Akpoti-Uduaghan, wey be Kogi Central Senator, con talk say she get serious complain about Senate President, Godswill Akpabio. She say e don use power pressure am for work matter.
Di tori long well well, but as Natasha drop her petition, who be di person wey suppose judge am? Na Imasuen! E look di paper, shake head, con talk say na ‘dead on arrival’. Di question now be say, how Imasuen wey get wahala for America take waka enter Senate Ethics Committee?
Who vet am? Who check im background before e enter di position? Dis kind matter don happen before. No be today Nigerian politicians dey get controversial background. Nigerians dey look, dem dey observe, dem dey ask question, but e con be like film for our front.
For America, if person get issue, e go face am, but for Nigeria, e fit still waka enter big position. Imasuen na example of how politics fit change person situation. But e get one thing wey Nigerians sabi do well—dem no dey forget.
Social media people don dig everything out, drag di senator sotay, e never talk anything about di mata. As dem drop di news say New York don disbar am since 2010, e never reply. E just dey hope say di matter go die.
But e no go die, because e go remain for internet like village oracle. E never clear if di Labour Party go act or if Senate go take action, but as e be so, e don show say Nigeria get im own way of handling things.
If na for better country, Imasuen for don step down since, but for here, e fit just maintain low profile small, before e go show face again like say nothing happen. Di question wey Nigerians dey ask be say, how ethics chairman go dey handle case when im own matter still dey ground?
If di Senate really wan do better, make dem look di matter well. But as e be, na di system wey we dey try understand.
Reference Links
- The Street Journal: Senator Neda Imasuen disbarred in the US
- Indepth News: Senate Committee on Public Conduct, Ethics, and Privileges
- Okay.ng: Natasha resubmits sexual harassment petition
- Politics Nigeria: Details of Natasha's petition against Akpabio
- Vanguard News: Demand justice for Senator Natasha Akpoti-Uduaghan
- Politics3 weeks ago
Natasha Akpoti-Uduaghan Wahala For Senate
- Politics3 months ago
Sowore matter for court show say wahala no go end soon
- Economy4 months ago
Tinubu Finally Talk: Na Real Talk Or Just Normal Politics?
- Politics3 months ago
El-Rufai & Tinubu Drama: Wetin Really Dey Happen?
- Economy4 months ago
Naija China Currency Swap Wahala – Who E Go Favour?
- Regional4 months ago
Fubara na Governor wey dey move Rivers State forward
- World3 months ago
Wetin Trump Immigration Law Mean for Nigerians Weh Dey America?
- Corruption4 weeks ago
Wahala wey dey follow money wey dem suppose use buy gun